Wednesday 16 January 2013

A fool and his money will soon part ways


Imagine all the money these fools make in this harsh winter weather, one spagetti-babe with leggings go just come collect everything for Summer.
If that one no happen, some fuji musician go enter fom naija dem go begin spray am like say na dem hold the key to the bank of England....dat 1 sef go just dey mention their name " Sina, Sina, Sina....Otunba Peckham1". When in actual fact no king dey for peckhamshire sef talkless say dem go give you chieftaincy title. Your head sef go dey swell...u go dey laugh like a maniac, dey dance like frog...dey spray money!!!
Go Ijebu- ode make u go see the kain mansion wey KWAM1 build. 4 huge buildings in one compound. Bulletproof doors, all fittings imported from Italy. Yet u wey dey spray am money still dey live for house where una dey queue b4 u take ur bath. If your ordinary 1 week bus pass lost sef u go dey cry like person wey Tiger kill im 1st born.
Mschew....A fool and his money will soon part ways.
Prov 17:16- "Wherefore is there a price in the hand of a fool to get wisdom, seeing he hath no heart to it?"
If dis talk wey i yearn vex you abeg no swear for me o. Na as d mata pain me na im make me talk o. In this weather wey water and mucus dey comot from agbalagba eyes and nose when nobody beat am....na im u go com dey spend the money anyhow? E ronu o!

No comments:

Post a Comment