Thursday 9 June 2016

Waste of time

While they were teaching us how to label the parts of a Grasshopper, our Chinese counterparts were being taught programming, and how to build the technology required to do surgery for the Grasshopper. 

See as we dey today.
Na monkey disvirgin some girls because dem want tablets and mobile phones wey secondary students for China produce.
With all our fanciful certificates, we no get answers to anything.
Common power we no fit generate.
Ordinary ear infection, President dey go abroad go find cure.
Graduates with their Bsc, Msc, Phd...dey carry placards line up for streets dey beg for employment.
Every year our Universities dey produce tons of Lawyers, Doctors and Engineers - see our shambolic legal system. Typhoid still dey kill people for our country. Structures dey collapse everywhere.
How many chartered accountants/ economists are being certified yearly by ICAN and other professional bodies, yet we can't find a team of 7 to prepare a solid budget! So tey we go dey plagiarise budget like we used to plagiarise final year projects at graduate school. So tan!

A whole State, including their governor dey on strike because no money to run the government, and sense no dey to generate any internal revenue.
Ordinary Aboniki balm, we still dey sell fake.
No standard, no control.

We have youths who are smart enough to empty the vault of the Bank of England, but none capable to configure a database system to hold the records of the citizens, which would facilitate better welfare system.
No accurate population census. Na so so population approximation wey dey do. Our government matter come be like father wey wan buy clothes for im pikins but no know how many yards to buy because im no sure how many pikin im born.

Only to dey blow grammar for social media na im we sabi.
If na to die for church and mosque we sabi, yet our hypocrisy stinks to high heavens.
If na to do wedding for Dubai, we sabi.
If na to drink the whole Ciroc distillery, we sabi

Nothing original wey we fit point to say we do...only to dey do copy-copy:
If dem wear crazy jeans, we go wear.
If dem put ring for nose like cow, we go do.
If dem dey carry Dre headphones, we go wan carry.
If dem wear Yeezy trainers, we go wan wear.
If dem drive G wagon, we go wan drive.

If somebody sew lovely shirt with Ankara, instead make we promote am, na to condemn am. When we come see Rihana wear Ankara, everybody go dey share the picture.
Even good music wey we sabi before sef don become a thing of the past.

Gbogbo nkan ti baje tan patapata bayi o! Aja 3 Nigeria o gbera mo o.

'Amukun eru e wo'.....de loro yi. Foundation wa ti rotten. Nothing we try to build on this can stand.

AV

No comments:

Post a Comment