Tuesday 28 June 2016

Our Wives

(At the market)

Woman 1: haha my friend, how you dey?

Woman 2: i'm fine o. Hawayu you too?

Woman 1: we thank God o. I just came to buy some vegetables and fruits. You look tired....

Woman 2: yes o...i'm just coming straight from work. I want to buy soup ingredients for the weekend. If I don't do it now, tomorrow will be very busy for me and my husband need to eat......you know as these our men be na.

Woman 1: Na you wan kill yasef o. I don tell you to follow my style. Me I don convert my own husband to vegetarian. I wan die with cooking? Now I just cut some slices of cucumber and put some lettuce and fruit Inside plate for him, na wetin im dey chop be dat o. Even the vegetable wey I come buy na Spinach, and na raw like dat im go chop am. I go just wash am, add small salt to taste.

Woman 2: my friend, if I try what you are telling me with my husband, na go I dey go so back to my parents. This one no be matter of referendum.  My husband wey be say if soup don pass 2 days Im no go chop am, na im you say make I dey give leaf chop like goat!
Abeg make I quick dey rush dey go....e be like say rain wan fall. I go dey see you some other time. Bye.

No comments:

Post a Comment