Tuesday 21 June 2016

Osun Student swaga

I just dey imagine say I be student for Osun State presently:
Hmmm...this morning, I for don enter our church vestry go carry the People's warden robe wear go school.
The thing wey funny be say, na me go get swaga pass because regalia yapa!

All colours of choir robes dey, vicar's warden robe dey, my papa's cassock dey...Infact some days na only white Surplice I go wear, some days I go use the Stole join am, dis one sef, na different colours dey available. Days when I wan appear corporate, I go wear only the clergy shirt with a big cross on my neck. Anyday when important something dey happen for school, maybe Governor or one commissioner dey come, or we dey do inter-house sport or inter-school debate, na dat time I go finish dem finally with my ceremonial vestment- I go nack the Damask Cope, come use the pope's cap garnish am.
Iyalaya anybody!

No comments:

Post a Comment