Wednesday 4 January 2017

Live in concert

After a 'LIVE CONCERT'

Guy1: Na which kain show you carry me come so?

Guy2: Wetin happen? You no feel am? The guys no try? You know feel the jamz?

Guy1: Oga hollup jo! Hollup! I ask you one question, you dey ask me 4! I say which kain concert you carry me come so?

Guy2: You sef hollup! You no know where we dey come before? You no see poster? Why you dey ask me nonsense question?

Guy1: No be LIVE CONCERT you say we dey come? No be 'LIVE IN CONCERT' dem advertise for poster? Wetin be all the rubbish wey dem do there? Wetin you just make me waste my money ontop?

Guy2: Wetin you mean? You no see the guy LIVE for stage? Guy, wetin you dey talk? Se na sleep you go sleep inside the hall? Wetin be your problem guy?

Guy1: Guy, you be fool I swear! You be confirmed foolish person. Is seeing the guy LIVE on stage not different from PERFORMING LIVE? When they advertised LIVE IN CONCERT to sell tickets no be to PLAY LIVE dem mean? Se na wetin happun inside that hall be dat? "Dj, track 3..... Dj, track 7....Dj, track 4....se na Live play be dat? I no blame dem. Na idiots like you I blame, wey no sabi the difference between LIVE PLAY and physical presence on stage. Dem know say most of their fans are Baboon like you dat dey can confuse and get away with. Mschew....

Guy2: Guy, no dey call me Baboon....you dey mad?! Just ignore the matter make we dey go. Dis year own don go abi wetin you wan do now? Guy, just forget the matter. Everybody groove...weda dem play back Cd or not. Even the Olori oko and im wife sef groove. Make we try dey complain less for inside this recession abeg. Make we try find some happiness somehow.

Guy1: mschew!

No comments:

Post a Comment