Saturday 1 October 2016

Operation 1 day, 1 miracle

Oya Oluwa let's go do it!
This month dey too crucial for me that's why i dey call you along.

Gege bi ajoso wa; keep me a step ahead of them.
Turn everything around me to doors and windows, make you come carry all the kokoro give me.

Correct my sight make i dey see far.
Adjust my hearing too make i dey hear from a distance.
Tune my heart make im catch the frequency where you dey broadcast.

Free my lane for me- no congestion.
Boost my stamina make i no quick tire.
I carry everything wey i get lock am for your safe, i no wan lost anything.

You know say e dey hard for me to smile before because i no sabi. Come teach me now not only how to smile but how to laugh and give me practical situations where i go fit practise wetin you teach me.

Everything wey you tell me for secret i don hear. Now i wan see and feel am. Na season of manifestation be this.

Operation 1 day 1 miracle...Yes i fit handle am.

No comments:

Post a Comment