Monday 24 June 2013

The Industry Millionaires

OJB is battling with a kidney problem. A donor has been found and he is in need of $100k (N16m) to carry out the operation.

Oya na all of you big boys in the industry come out and help your colleague o. Don't wait to enter studio to sing tribute song o. We no go buy am. Na all your songs dey mention say una get stupendous wealth, oya help your brother.

Whizkid (wey say N500k na chicken and chips money for am) o ya come help your brother. We know say "your money and their money no be mate". Omo jaiye-jaiye, No buy another N50m Porsche. Save a life...you know this man's impact in your carreer.

D'banj and his $50k watch, $20k suit no look your brother make im die o. Eja nla open your Versace wallet.

Iyanya you just sign N60m contract with MTN come out come help. All we need now is your change not your waist.

2face abeg come spend some of this Dubai money o. Na this man produce the song wey lauch you - 'African Queen'.

Don Jazzy and his N60m Porsche, abeg drop something.

Davido (OBO), you don get enough gold chains o. Abeg save a life!!!

P-square and dem mansions and jet, biko drop something for your guy o.

Banky W, Eldee, Dr Sid, Olamide, Wande coal, Timaya, May D, Burna Boy, Ice price, MI, D'Prince - na all of una dey sing say una dey swim inside money o. No allow this man die o. If una no drink Champagne for 1 weekend una no go die o. Abeg gather money help this man.

We only need prayers from 9ice, blackface, faze, Idris, Tetula, Terry G, Lord of Ajasa etc. Nothing more.

All of you wey i mention, if una fit contribute N1m each money don complete o be dat o. Make una no expect say na the public go contribute this money o. Public wey dey earn N35k a month ....we no get o!!! Mekunnu no get money o!!! Igboro o rerin at all.
If this man die...shame on all of una. Make none of you sing say you don blow or you are balling again o.

Lastly, i want advise una ontop all these reckless spendings and lifestyles wey una dey live. Se una see now? Una go dey consume alcohol like say na water...dey smoke like say una be first born of sango. No savings yet una health dey deteriorate. Na only last week i talk this thing o when whizkid crashed im Porsche.... see e don dey happen.

Be wise and guided. E f'eyi kogbon o.

No comments:

Post a Comment