Monday 24 June 2013

Raising or lowering the bar?

Jamb cut off point si ma di 30marks. In this era of BB, twitter, FB, 2go. E ti mo nkannkan.

Who wan go skool again when u can pick up the mic and sing "Na na na na-na na na" and blow big enough to buy Porsche.

Who wan read again when you can open free twitter account and easily tweet ur naked pix and baba olowo go invite you come Abuja from there to Paris and London.

Why you wan dull yourself dey read book when you can go to the gym, rip body badly, get a DJ to cook a beat for you, get on the stage and comot shirt begin seduce all the babes and you have a sold-out show in London.

I wonder why Ministry of Education never realise say nobody get time for Jamb again.
J A M B in this age and time? When all you need is a laptop and format- just 1 hit and you can set Oniru on fire?

If at all it's compulsory to enter 'ogba' dem no dey settle again? Mschew......

Abeg next story jawe.....!

No comments:

Post a Comment