Tuesday 9 April 2013

Why una dey fear?

Obama and im family dey go church service on Easter Sunday dem waka for road like every other normal human being. Dem no close road because of dem. Security no shoot teargas. Nobody chop koboko.

Iyawo Governor wan go buy pepper, e wa ti Mile 12 pa.
Iyawo President dey come lagos, una close 3rd mainland bridge....

No be mekunu vote una for there? Ok let us assume say na ur money u take rig election reach power, no be mekunu una dey govern? So why una dey run away from them?

After u don give dem good roads, constant electricity supply, good health facility, quality educational system....se dem go still hurt you?

Why una too dey fear?

2 comments: