Wednesday 10 April 2013

Horror-Comedy Movie

Nigeria just be like Horror-comedy movie.

I still dey watch wetin go happen with this BH amnesty issue.

I wan see names of those wey go dey govt payroll dey collect money. No be ghost dem call dem? Wetin dem wan take naira currency do? Se currency aye ba torun mu ni?

I wan see wetin go happen to the innocent victims wey dem don render homeless, some pikins wey don become fatherless.... women wey don become widows and husbands wey no get wives again. Se nothing for those ones? And you want to dey pay people wey distabilise their lives? Which kain money make we call dat one?

I wan see which group go spring up after BH to come unleash terror on the country just to claim their portion of the national cake as well. Sebi na after niger/delta militant boys na im we begin hear about BH.

Issokay.....make i go buy fuel put for standby for the generator i must watch the movie finish o.

No comments:

Post a Comment