Tuesday 22 October 2013

Seek help or die forming

Some pple dey dere dey envy you say you dey London. Dem no know say na ontop heater for room you dey dry your clothes.
No backyard, no balcony, no sun.
If to say dem know how many functions dat ur single room dey serve and how much u dey pay, dem go begin pray for you instead of envy.

But sometimes no be dem fault o. na you sef dey do yoursef o becos you dey give false impression.
When you go tell dem the kain job u dey do?
When you go tell dem say na your neighbour get dat car wey u dey take snap all the time?
When you go tell dem say sometimes you no dey comot tag from clothes you buy becos u go return am back to d shop after u don use am show finish to either get a refund or exchange?
You no get PS yet u dey follow dem update status when GTA V was released just to feel among. So why you come dey vex when ur bro say make you send ipad3.5 to am? Why you dey vex when your paddy ask you for note 3, abi no be you dey mislead dem?

Eniti ko ti jeun to fi toothpick s'enu? Is that faith or foolery?
Na you dey give wrong signal to your helper.
Dem go ask you why you no go work, instead make you confess say you no get work make dem help you go dey say you be self-employed now....say you now deal in cargo and shipping. Haa...aye e de nbaje lo pelu iro ati fake packaging.
Iwe awon agba ori 16 ese keji wipe : "j'ewo obun ki won le d'aso ro o." Verse 5 tun so wipe "enikan kii f'owo to ndun pamo s'abe aso." if you read further to verse 22 o tun emphasise e wipe "oku kii farapamo fun eniti o ma we ohun"

O ku si e lowo. But imoran mi fun e ni wipe LIVE A TRANSPARENT LIFE.

No comments:

Post a Comment