Tuesday 22 October 2013

Eyebrowing

When you see some ladies, you go think say dem dey vex but na just their eyebrows dey give wrong signal. Dem don shape am so tey the thing don turn to their faces to a frown.

Some of una jus dey disturb God with prayers say make im send you life partners. All the ones wey im don send nko....no be strong face dem see wey dem run comot? They always say "haha that lady is never smiling" dem no know say her soul dey smile but na face refuse to.

If you belong to this tribe of Idiagbon, simply go and correct those sadistic eyebrows.


Allow God to rest o. Im don hear ur prayers.

No comments:

Post a Comment